Man dies during sex with prostitute..nawa o!!!

Naija News – Man dies during Sex with prostitute
185 Comments
”No be me kill am O!  Di man kpeme as I dey duty. Im dey vibrate, I tink say na better tin dey worry am , asheey na die e de die and foam begin comot for mouth” ”  Miss Peace Idorenyin di prostitute wey dey duty de talk.
Na so Mr Samuel Ete who live for Calabar don go meet im maker. E get wife with pickin but dey go outside dey find wetin no fin am. As lover boy leave im family go find ashi for calabar zoo side, e no know say im dey go kpeme.
AS police come, dem talk say no be di woman fault, but she dey under detension make she help solve di case. Naija Police!!!! Olokpa people, which kin detention , una wan kpeme too? She talk say she for run but as she no say no be her fault she stay call police. She say she get many customer and none of dem don die so she know say her hand clean.
Paradise! oh Paradise! RIP Ete .
Funny Testimony
Praise the Lort. Hmmm! It’s not a small something. Well, actually, it all started a two day ago, which i’m in my house, so a small hungry is catching me, so i look in the house nothing much to chop only small plantain which i’ve not fried before. So, i tell myself to fry it and chop, as i’m frying that plantain so, phone ringing, so i look, it’s a faring place, so i now run, which i reach there, it’s my father which call, so i now say, father call after, plantain frying. I keep it. So now, i now turn around, as i turn around, all of a suddenliness everywhere in my house have turn to smoke.
Children of God as i’m approaching, smoke is biging, smoke is just biging biging. It’s a fearing thing o!, if it’s you self, you’ll fearing. So i now call on my God, i sing his sing which daddy say make we dey sing. The sing did not work oh! Smoke is still biging make i talk true. So i now call the name of Jesus three times. I shout Jesus, Jesus, Jesus! All of a miraculously, smoke start to be vanishing, to where? I no know. It’s a miracle thing. Smoke start to small, small, small. Then, my plantain have burn to ashes. Hallelujah.
But my main testimony today be say, i chop that charcoal and nothing happen to me, church praise the Lort”.

No comments:

Gospel Singer Tasha Cobbs Faces Backlash for Teaming with Racy Nicki Minaj on New Song.

Gospel Singer Tasha Cobbs Faces Backlash for Teaming with Racy Nicki Minaj on New Song. Grammy award-winning gospel singer Tasha Cobbs-L...